"Kalakuta Show" lyrics - FELA KUTI

FELA KUTI
"Kalakuta Show"

Paroles de la chanson Kalakuta Show:
KALAKUTA SHOW

Make we talk something
We never talk before and
We dey see am everyday
(Ahh...Ohhh...Sh-sh-sh-sh-sh)
[2x]

Look de man he dey waka
GAGA GUGU GAGA GUGU
[repeat]

Hungry dey run for him face
WOKO WOKO WOKO WOKO
[repeat]

Him pepeye cap for him head
PEPE PEPE PEPE PEPE
[repeat]

Him khaki woolen shirt for him body
WULU WULU WULU WULU
[repeat]

Him trouser dey fly above him knee
YAYA YAYA YAYA YAYA
[repeat]

The people wey employ da man
Give him permit to carry the thing
Weh bad
Dem give him permit to carry baton
Dem give him permit to carry tear-gas
Dem give him permit to carry bullet
Him fit carry basket for protection too
Na so we dey see am every day
No so he dey happen every day

One day
SATURDAY

One day
SATURDAY MORNING

The whole thing change

One day
5 A.M

One day
NOVEMBER 23

The whole thing change

One day
1974

One day- Kalakuta Show

One day
SATURDAY

One day
SATURDAY MORNING

Kalakuta Show
1979

Kalakuta Show

Dem make sure dem
Use tear-gas, baton & bullet
[repeat]

Dem use them basket
For protection too
[repeat]

Dem do one thing
Dem never do before
[3x]

Dem-o hire... axe-o... dem-o bring... cutlass

DEM-O HIRE... AXE-O... DEM BU-RING... CUTLASS

[repeat under verses:]
Kalakuta show-o-o
Kalakuta show (una na na na na na na na na)

Kalakuta Show [2x]

Babu wire dem-o cut
Look fence dem break
Look gate dem fall
Everybody dey run
Look head dem break
Look blood him dey flow

Kalakuta show o-o
Kalakuta show
Na na na na na na na

Look loya** him dey come **(lawyer)
Him he loya him dey come
Look loya dem beat
Look loya him dey run
Look loya him dey run

Kalakuta show o-o
Kalakuta show
[Etc...]

[Organ solo]

[Sax solo]

[End with bass/percussion under solo sax]